The way i dey see this country. 🤔

After 29th may if them do wetin dey their mind, I go just go Lapo use my land borrow 50M, go Access bank use thesame land borrow another 50M., make Access bank and Lapo dey fight for one land 😂. Then fly out to cotonou. Wow....  😎you know i always think fast. When I reach cotonou I go enter their chief palace do dorime of 95M make e know say yes investor don enter their country 🙄. 

Oh God ... then the remaining 5 million i go use 50k invest for real estate 😏 then 4.950M wey remain i go squander am then come back to 9ja. If Lapo and Access bank come find me i go sing this song for them 


"He paid the debt he did not owe...

I owed the debt I could not pay 

I need a some to wipe my debt away " 😩

#officerikoku

Comments